My fellow Nigerians;
Which kin democracy be this?
Egba mi o!
Everyday people dey quench;
Yeparipa o!
Which kin democracy be this?
Wey Tompolo and Asari dey;
Dem Boko dey! 
Dem Obatse dey!
Robbers dey! 
Plenty, plenty looters dey!
Which kin democracy be this?
Tompolo get power pass president;
Asari get power pass president;
Egba mi o!
This one na real demoCRAZY!
Demonstration of craze;
Crazy demo, democrazy;
Crazy demonstration;
Demonstration of craze
==DEOLA




No comments:
Post a Comment